9ja FlavourNigeria Football

Super Eagles new coachie Rohr go dey collect $47,000 salary

We don get de confam amebo ontop how much wey Naija new coachie Gernot Rohr go dey collect and who go dey pay am hin salary.

According to African Footballna $47,000 de Germany man go dey collect every month. If pesin convert dis money to naira e mean say na about 18 million naira Rohr go dey collect be dat.

Dis one pass 5 million Naira wey befor befor coachie Sunday Oliseh bin dey collect befor hin resign for February.

Rohr bin sign two-year contract wit Naija Football Federation (NFF) inside dis month and na Dr. Ifeanyi Ubah oil company go dey pay hin money.

De coachie wey don work for Niger and Burkina Faso go start work wen Naija and Tanzania enta one trouser for Uyo for AFCON qualifiers..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x