9ja FlavourNigeria Football

Super Eagles players don dey train for Uyo for Tanzania match

Twenty Super Eagles players train on Tuesday as Naija dey prepare down for dia last 2017 African Cup of Nations qualifier against Tanzania for Akwa Ibom International Stadium, Uyo.

Coachie Gernot Rohr dey dia as oga boss for de training for de first time since dem don dash am de job.

De 20 players wey dey camp now and wey train on Tuesday na:

Goalie keepers: Emmanuel Daniel and Ikechukwu Ezenwa

Defenders: Musa Muhammed, Chidozie Awaziem, Abdullahi Shehu, Jamiu Alimi, Leon Balogun, William Troost-Ekong and Elderson Echiejile.

Midfielders: Skippo Mikel John Obi, Ogenyi Onazi, Wilfred Ndidi and Nosa Igiebor.

Forwards: Brown Ideye, Imoh Ezekiel, Kelechi Iheanacho, Victor Moses, Odion Ighalo, Victor Osimhen and assistant skippo Ahmed Musa.

But Moses Simon and Kingsley Madu go join body wit de team on Wednesday.

And we get correct amebo say Tanzania players go enta Naija for de match on Thursday..

 

Photo Credit: Soccernet.com.ng

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x