9ja FlavourNigeria Football

U-17 AFCON qualifiers: Golden Eaglets don ready to tap ball wit Niger tomorrow

De second leg of Under-17 AFCON qualifier wey go shele between Golden Eaglets of Naija and Niger Republic go kick-off by 4pm (Naija time) on Saturday.

De match go shele for artificial turf wey dey inside Stade Municipal de Niamey. De first leg end 1-kondo as de Naija boys waya Niger for Abuja.

De Naija U-17 team don land for Niamey and dem kack well for Royal Palace Hotel for dia.

Som of de players dey yarn befor de match already.

“We tanda wella for de Nigeriens o,” skippo of de team Abduljabar Sani relate all man.

“Na de first time wey most of us go comot for Naija be dis and we still wan comot again and dat one mean say we must waya Niger to qualify enta next level be dat.”

Defender Solomon John sef add hin own: “Dis match important for our career and wetin Governor Tambuwal tell us befor we comot Sokoto na say make we try we best do well rep Naija.”

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x