9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Anichebe joins Sunderland for one-year contract

Naija striker Victor Anichebe don join body wit Sunderland for free transfer till end of season for Premier League.

De 28 years pikin bin play 130 times for Everton when David Moyes be coachie and hin don sign one year deal for Sunderland.

“I dey joli say I dey dis kain great club today,” naso Anichebe relate de Sunderland website.

“I get plenty friends for here and dem know say I sabi de manager wella. Moyes helep my career from when I small and e go helep me wella.”

De befor befor Everton and West Brom player bin turn free agent afta West Brom release am afta last season.

Na 11 times Anichebe don play for Naija Super Eagles and hin score just once against Kenya for padi-padi match..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x