9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Emenike tear net for Fenerbahce as hin land back for Turkey

Befor befor Naija striker Emmanuel Emenike tear net as hin return go back to hin club wey dey Turkey, Fenerbahce for play-play match wey dem follow FC Voluntari play.

De Turkish club bin flog Voluntari 3-1 and Emenike na hin score de first goal for de match inside 12 minute.

emmanuel_emenike_fenerbahce_gol_sevinci

Na Ramazan Civelek and Melih com later score de other two goals wey Fenerbahce use tear net end match for 3-1.

De 29 years pikin bin dey Al Ain last season as de Qatar club borrow am from Fenerbahce but dem borrow am give West Ham again befor season finish but hin no put beta swagger for hin matches wey hin tap for de two clubs.

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x