9ja FlavourNigeria FootballNigeria Professional Football League

Too much money! Gov. Wike dash Rivers United players N7m after dem waya 3SC

Executive governor of Rivers state, Ezenwo Nyesom Wike don dash players of Rivers United seven million naira after de boys kpokpo Shooting Stars SC 2-kondo on Sunday as hin take promise dem.

De governor bin dey for ground Yakubu Gowon Stadium, Port Harcourt as hin boys dey rubbish Oluwole Warriors and hin don yarn dem say hin go dash dem de money if dem fit win to take ginger dem wella.

Rangers climb table to No.1, Wikki draw Tornadoes as Enyimba waya Pillars

3-19

Rivers United don show beta sabiness dis season as dem dey number 3 for table now wit 44 points and dem still dey for Federation Cup dey make sense.

No be only 7 million de players go collect dis season as de governor don yarn say hin go dey dash dem 3.5 million naiara anytime wey dem play draw for away dis season and if dem win for away dem go kolobi 7 million naira again.

Wike also bin promise say hin go dash de players $50,000 if dem fit beat anybody wey qualify com play dem for quarter final of Federation Cup inside Enyimba or J.Atete.

Na joli time for Rivers United now o, all dem need to dey do to dey live Dangote life na to dey win dey go..

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x