9ja FlavourNigeria Football

‘NFF go toast Salisu Yusuf to follow oyinbo coachie work’

Oga bosses for inside glass house of de Naija Football Federation (NFF) don let man sabi say NFF go follow Salisu Yusuf yarn say make hin helep us follow foreign coachie wey dem wan appoint as head coachie work.

Yusuf bin don yarn NFF say hin no wan dey assist again say hin wan be head coachie or make dem no call am again but NFF still wan toast am make hin gree to assist de new oyinbo coachie wey dem wan get.

salisu-yusuf-soccerblitz

De 54 years man don assist Stephen Keshi, Sunday Oliseh and even Samson Siasia befor but de guyman don tire and hin dey part of coachies wey dey de 3-man shortlist.

ALSO READ: NFF don release names of pipu wey wan chop Super Eagles coachie

One of the oga bosses for NFF follow African Football yarn say dem go follow Yusuf talk ontop job wey dem wan give am after dem don announce who go be new coachie of Super Eagles inside Tom Saintfeit and Paul Le Guen.

“Our pipu wan make Salisu work wit de new oyinbo coach but no be under am o. Hin go dey collect lesson from de guyman and de plan na say hin go be coachie after de oyinbo coach don go,” naso de official relate African Football.

“Dem really dey hope say hin go gree dis level wey we get for am. Hin go even help sef becos hin don dey follow de players work for more dan one year sef.

“Na hin go be coachie of de home-based Eagles sef. Make e no be like say hin just dey dia. And all de salary wey dem no gree pay befor go enter hin account.”

De NFF executive committee go let all man know who be de new coachie on Monday..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x