9ja FlavourNigeria Football

NNL Match Day 11: As all de matches take shele wit scores and tables

Kogi United waya Sokoto United 1-kondo for match day 11 Naija National League (NNL) wey shele for Confluence Stadium, Lokoja. Na Abubakar Tenimu tear net for Kogi United for 42 minute wit penarity.

For oda Division A1 games wey shele, Shekarau Babes flog FC Yarmalight 2-kondo, Jigawa Golden Stars sef no dull de package as dem waya Katsina Utd wey dey top table 1-kondo, but Mighty Jets home game wit Kaduna United no gree finish as dem abandoned am for 52 minute.

For inside Division A2, Dreams International FC of Makurdi climb to top of table again sef dem kpokpo Kwara United 1-kondo for Aper Aku Stadium. Na Dreams goalie keeper, Obioma Sunny tear net wit penarity for 53 minute. De Benue Army dey ontop of table wit 22 points now and Kwara United dey follow wit 20 points.

For oda games for Division A2, Zamfara United claim oga boss over Wikki Tourists Feeders wit 3-1 away win, Gombe United walk over FC Taraba and Supreme Court beat Adamawa Utd 2-kondo.

Inside Division B1, Prime FC and Remo Stars draw like ogbono 1-1, but as per amebo wey we get one Prime Fc fan chook Remo Stars player sharp somtin out of vexation.

For anoda match, Delta Force beat COD United 2-kondo, Unicem Rovers win 2-1 over Go-Round FC and Abia Comets play 0-0 draw wit Akwa Starlets.

In Division B2, Firstbank FC beat ABS Ilorin FC 2-1, Gateway Utd waya Bayelsa Utd 3-1 and Bendel Insurance claim oga boss over Cofine FC 2-kondo.

NNL RESULT MATCHDAY 11:

DIVISION A1:
Kogi United FC 1- 0 Sokoto Utd
Mighty Jets FC 3 – 0 Kaduna Utd (Match was abandoned by Kaduna Utd in the 52nd minutes)
Shekarau Babes 2 – 0 Yarmalight
Jigawa Stars 1 – 0 Katsina Utd

DIVISION A2:
Wikki Tourist Feeders 1 – 3 Zamfara Utd
Gombe Utd – FC Taraba (W/O)
Dreams Int’l 1-0 Kwara United
Supreme Court 2- 0 Adamawa Utd

DIVISION B1:
Prime FC 1- 1 Remo Stars FC
Delta Force 2 – 0 COD United
Unicem Rovers 2 – 1 Go-Round
Abia Comets FC 0 – 0 Akwa Starlets

DIVISION B2
Firstbank FC 2 – 1 ABS FC
Gateway Utd FC 3 – 0 Bayelsa Utd
Bendel Insurance 2 – 0 Cofine FC

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x