9ja FlavourNigeria Football

Paul le Guen no fit be Naija coachie becos hin no wan live here – NFF

De Naija Football Federation (NFF) don finally let all man know de comma wey dey for de appointment of Paul le Guen as new Super Eagles coachie.

De Naija football oga bosses don yarn am for dem website say dem no fit do business wit Le Guen sake of say de coachie no wan dey live for Naija and hin no wan collect de target wey dem bin set for am for Super Eagles.

NFF don announce Paul Le Guen as new Super Eagles coachie, but comma dey!

“As we dey try do de final agreement, hin (Le Guen) tell us say hin no gree to our target wey we give am and hin no wan stay for Naija,” naso NFF executive committee member Suleiman Yahaya-Kwande take relate.

“Head coachie work na serious work for Naija and we no fit dash pesin dat kain job witout target.

“We no get any wahala to find pesin wey go coach us o. Plenty pipu go joli if dem dash dem dis senior national team work.”

Yahaya-Kwande yarn say NFF still dey find how dem go chook pesin put for de coachie post wey Le Guen no collect.

“We get plan to put anoda pesin sharpaly. Dat one no be wahala,” hin confam.

But NFF bin later yarn am say dem bin no appoint Le Guen as coachie befor say na only recommend dem recommend de coachie and na wetin dem tell all man be dat..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x