9ja FlavourNigeria Football

Rio 2016 Olympics: Naija go tap ball wit Colombia for football event

Naija Olympic team, Dream Team VI, go follow Colombia enta one trouser today for Rio 2016 Olympics men’s football event for dia last match for group B.

Naija don graduate enta next level wey be quarter-finals as dem waya Japan and Sweden for dia first two matches and de Colombia own go be like play play, but de South America team need beat de Samson Siasia boys becos dem need de three points like how man wey dey desert dey need water.

Colombia dey second for table wit 2 points. Sweden go follow Japan play for dia own match and anybody still fit follow Naija qualify as de two of dem get 1 point each.

Coachie Siasia don yarn say hin go allow players wey dey sidon for bench since play for de match as dem sef no just com look for Rio.

Hin yarn say since Naija don graduate enta next level som players need rest and odas gaz play as per say na wetin dem kuku com do be dat.

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x