9ja FlavourNigeria Football

U20 AFCON Qualifiers: Osimhen tear net as Flying Eagles waya Sudan for house

Naija U-20 team gain beta confido to carry enter second leg of dia 2017 Africa Cup of Nations U20 qualifier wit beta win for inside Al-Merrikh Stadium, Omdurman.

Samuel Chukwueze and Victor Osimhen tear net to score de first and second goals as Flying Eagles of Naija go kpokpo Sudan U-20 team for inside dem backyard 2-1.

Victor-Osimhen-celebrates-after-scoring-for-Golden-Eaglets-against-Brazil

Na Mohammed bin score for Sudan wit first goal of de match for 27 minute of de game.

But Naija bin ginger dia swagger back for second half wit plenty attack wey dem carry com and Chukwueze helep de Eagles tear net to equalise 1-1.

De Naija boys no rest wit draw o. Dem still dey terrorise Sudan life to take score anoda one to win and Osimhen na de correct Bin Laden for de terrorist attack as hin tear net four minutes to close shop.

Naso Naija waka comot from Sudan like bully wit beta win. De second leg match go shele for Naija in two weeks time.

If Naija win or draw for second leg dem don qualify for U20 AFCON wey go shele for Zambia next year..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x