9ja FlavourForeign LegionNigeria Football

Pius Ikedia almost kpai for Ajax exhibition match

Befor befor Naija winger, Pius Ikedia for exhibition game wey involve befor befor Ajax players and Lucky Ajax for jolification of 50th anniversary of the Haarlo Sports Club for Satiday evening.

Ikedia, wey bin represent Naija for 2002 FIFA World Cup, later com back to normal afta dem rush am go hospital.

“De 36 years pikin winger bin disappear ontop pitch and dem need to revive am many times befor dem later rush am go hospital for beta treatment,” Telegraaf relate.

De tin shele few minutes to wen de match almost finish and Lucky Ajax don dey waya dem opponent 7-2 for de match.

De guyman bin tap ball 15 times for Naija Super Eagles and hin score just one goal..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x