9ja FlavourNigeria Football

Zambia no dey fear Naija at all

Oga boss for Zambia Football Association Andrew Kamanga get beta confido say Chipolopolo of Zambia go beat Naija Super Eagles for World Cup qualifier match wey de two teams go play for October.

Just like Naija, Zambia sef no fit qualify for 2017 AFCON wey go shele for Gabon but de presido yarn say dat one no go stop dem as dem wan qualify for World Cup for Russia 2018 by force.

“We no fit afford make we no go World Cup o,” naso de guyman yarn Zambia Post.

“We no fit lose hope befor dem play match nah. De players believe say dem fit win am against Naija. Why we go dey doubt am?

“Coachie wey dey dia now [Coach George Lwandamina] don dey do beta job since so if new coachie no com e no change anytin. We need prepare wella and plan wella.”

 

 

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x