9ja FlavourAfrican FootballNigeria Football

CAF Champions League: Sundowns waya Zamalek to get beta advantage for Enyimba group

Mamelodi Sundowns of Southy waya Zamalek SC of Egypt on Sunday to take chop oga boss for Enyimba FC group for only CAF Champe League match for Group B.

CAF don chase ES Setif comot from de tournament if not dem for tap ball wit Enyimba for de second match of de group.

Oyinbo: CAF Champions League: Zesco beat ASEC, Zamalek lose to Sundowns in Egypt

2016-636043987737733683-773

Mabunda and Billiat na dem tear net take helep Sundowns waya Zamalek 2-1 for inside Egypt.

De result mean say Enyimba still dey for yansh of de table and Sundowns dey ontop wit 6 points but Zamalek tanda for second wit 3 points.

People’s Elephant next match for Champe na on August 14 for Zamalek house and last match na against Sundowns for Naija on August 23..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x