9ja FlavourNigeria Football

CONFAM: NFF don kolobi Gernot Rohr as new technical adviser for Super Eagles

De Naija Football Federation (NFF) don appoint Gernot Rohr as new Technical Adviser of de Super Eagles.

NFF yarn all man for dia twitter account on Tuesday say de Germany guyman don sign two years contract as hin don do all de paper waka finish wit dem.

 

https://twitter.com/thenff/status/762987710600675328

Rohr, wey be say na hin dey enta after Sunday Oliseh bin resign for February, go get de WAEC job to qualify Naija go 2018 FIFA World Cup wey dey shele for Russia even as Naija dey inside group wey strong like stone. Zambia, Algeria and Cameroon dey Super Eagles group.

But de 63 years man go start hin work when Tanzania com play Naija for Port Harcourt for 2017 AFCON qualifiers next month.

Rohr bin coach Bordeaux wey hin bin play for sef as defender and hin carry dem enter final of UEFA Cup for 1996 but Bayern Munich waya dem.

Hin don coach Nantes too befor and African teams like Etoile du Sahel, Gabon, Niger and Burkina Faso..

What do you think?

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments

Related Articles

Back to top button
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x